By Promise Odejide For Naija, fuel subsidy dey cause wahala, E don dey tey, e don turn kolomental palava. Government talk say dem go remove di subsidy, But Nigerians dey vex, dey ask for clarity. People dey suffer, fuel price dey skyrocket, Naso transport fare come dey overtake night flight. Economy dey shake, people dey complain, Wetin dey happen, na so we go remain? Fuel scarcity dey reign, queues dey long, People dey shout, say e don do, e don do wrong. Fuel stations, dem lock up, no fuel to sell, Na frustration and hardship, e don turn our dwell. Subsidy na money wey dem suppose save, But e seem say na pocket money dem dey rave. Politicians dey chop, while we dey suffer, E be like say our leaders dey turn us to buffer. Naija people, make we rise, make we demand change, Make we no dey accept dis subsidy derange. We deserve better, make we fight for our rights, Naija no suppose be like dis, we need daylight. Government, hear our cry, address our pains, Fuel subsidy p...
Be seen, heard, remembered... Memories count